MY NPC ENTRY FOR TODAY ABOUT "WENTIN FRIENDLY ENEMY DON DO ME..
npc·@adelax·
0.000 HBDMY NPC ENTRY FOR TODAY ABOUT "WENTIN FRIENDLY ENEMY DON DO ME..
Hello my people, my people no me, i no my people. I dey write you another pidgin tori wey my mama @ogoowinner say make we talk about " wetin friendly enemy don do me" I wan yarn you about a short story of wetin friendly enemy don do me He get one of my friend wey I love so much like my brother. We una dey The same school together. Na me rent room wey we dey sleep together na me Even dey cook for this my guy. Everytime he need money na me he dey Come meet. And as me be small boy I just dey do my own. I dey sponsor this My guy. He even snatch my girlfriend and he dey tell me say na my girlfriend Dey flirt. I no even talk I just dey do my own. You know wetin come pain me pass be say this my guy come chop up now for All this there yahoo stuff he Don even get car self. Since then this don my guy chop up He Don ran away from me oh. He no even call me or pick my call. He dey pain Me seriously because I don spend money for this my guy and at last Na me lose. That's my short story about wetin friendly enemy don do me. Thanks to our mother @ogoowinner for giving us this chance To talk in pidgin. We na dey greet you oh happy sunday  Image source miss queen ogoowinner