Naija Pidgin Challenge: why I like steemit
npc·@admiralsp·
0.000 HBDNaija Pidgin Challenge: why I like steemit
http://dailypost.ng/wp-content/uploads/2012/10/UNIBEN.jpg [Image Source](http://dailypost.ng/wp-content/uploads/2012/10/UNIBEN.jpg) *Uniben Main Gate* # MAKE I YAN WHY STEEMIT DEY MAKE ME JOLLIFICATE Steemit dey jones me ooo, chaii unto area boy wey(Warri) I be, we don de subscribe de press paino for long but still no shows, so when oshare yan me steemit, i be like "oshare you don start again" but nor be so steemit dey deliver steady, but based on say i don de run tinz online since i still de ask for evidence before i involve pit, you know how the thing go. So oshare come show me evidence omo na so quick quick i involve, make express for nor pass me. Since I galant for this platform, I don make waves in many ways, this nor be eze goes to school or chike and the river, this na the koko, steemit nor be like all those ponzi when paul gots pay peter, because the day paul nor get that means no show for peter, and that one mean say kasala don gas be that. Since I make steemit my papa compound i don de clean, my thoughts don improve unto say na correct guys and chokos i come de parol with, them dey give me formats all the time to make sure say I nor slack for back. And to come top the mata kpatakpata steemit don give me avenue to show myself and shakara based on say I fit yan about waitn de sweet me, or waitn de pain me, show my talents, infact anything wey sweet you, nor be say shoot bird mama fly, check am out now, we get different places for those when sabi write, those when sabi sing, those wen sabi dance, even sports balance for the matter,na food that one dey too, na culture e involve for the matter, abeg if i begin count scores we nor go piante comot here,so make i match break for here. If you know say i yan your mind and you like all waitn i don spit for here,make you show your boy love cause my battery low for this side. # UPVOTE || COMMENT || RESTEEM One love my people.