WHY I LIKE STEEMIT (NAIJA PIDGIN CHALLENGE)
npc·@enajo·
0.000 HBDWHY I LIKE STEEMIT (NAIJA PIDGIN CHALLENGE)
<center></center> [source](https://travel.jumia.com/blog/ng/wp-content/uploads/2016/02/tinapa.jpg) _Tinapa resort cinema house_ >cassava today fit be gari tomorrow Before I come join steemit, I swear life bin no easy o. I be student but unto say I be guy I no dey the one put hope for old-boy, I dey one try do waiting I fit before I go call house make them show me love. The koko were dey be say most times them go still tell me say e no dey. >E go better na e go better, na im make ibo man still dey Kano. Before steemit show my side,facebook, whatsapp and nairaland bin the fight for me, but na "nairaland" bin win. One day, my right hand man @ugest come the yarn me of steemit but I tell am say I no go do that kind thing base on waiting bin do me for mmm, ultimate cycler and the rest. After much talk, I say make I just do am. Now see where I dey. God bless you @ungest. As I bin start for this place eh, everything con dey change. That time I fit write nothing comot but now I dey see at least $1. >If life dey show you pepper my guy make pepper soup. Now steemit don help improve dey way I dey read and write. If to say person bin yarn me before now say I go fit the write the way I dey do now I no for believe. Finally, because of steemit I don meet so many people from all over the world. I Don go places were I no bin fit the enter before now. God bless steemit. >come for the money, stay for the community. Before I end this post make I throw-way salute give my boss them @ejemai, @tojukaka, @ungest and @biggijay. Make I follow take this chance thank Our big anty @ogoowinner where follow join hand give me chance to tell una why me like steemit. God bless all of una.