HOW WE TAKE SEE THE CHANGE WEY APC PROMISE US (E REACH YOUR SIDE?)

View this thread on: d.buzz | hive.blog | peakd.com | ecency.com
·@naijapidgin·
0.000 HBD
HOW WE TAKE SEE THE CHANGE WEY APC PROMISE US (E REACH YOUR SIDE?)
![DQmUKSUbJf6GJypWe3AotmHNRN95riKkHAk52cqMRqfHJ2x.jpeg](https://steemitimages.com/DQmUKSUbJf6GJypWe3AotmHNRN95riKkHAk52cqMRqfHJ2x/DQmUKSUbJf6GJypWe3AotmHNRN95riKkHAk52cqMRqfHJ2x.jpeg)

*My country people I trowey salute for unah o…….*
*How unah dey?*
*How we take the hold body for this change wey dey rub everybody so…………?*

So today I want welcome unah in an ogbonge way come this our blog where we take the rub mind about how e take the be us for this naija, all for we pidgin language.

So today tori wey we carry land unah domot nah about the change wey APC promise us when them been want enter government.

Nah true say when country want change hand for government, all the whole party wey want rule go come promise the country people heaven and earth, dem go give us all the sweet mouth wey dey dis world just to say make dem win.

Nah so APC come promise us everything and as e be say Nigerians don tire for goodluck government nah him them pursue am comot from sit bring our BABA (buhari)

>hmmm they take say you no go value 
wetin you get until you no get am again…..

Nah so dem promise us say……….
Dem go pay all the youth wey no get work 5k stipend every month.
Dem go fight corruption return all our money wey them been thief.
Dem go create plenty jobs for the country so that everybody go see work do.
Dem go repair all the roads wey don spoil.
Dem go make sure say money reach everybody.

In fact eeh me I no fit remember all wetin dem promise us sha…….. And right now baba tenure don almost finish me I never say anything wey dem don do instead na spoil things just dey spoil dey go.

Even the 5k wey me I happy for because work no dey e no even reach my hand.

My people abeg how we go do this matta?
Election time don dey reach again o.
And unah know say this naija nah we own

Unah still want make APC come back come continue the change we dem promise us..?
Abi the change wey dem promise reach your side?

**abeg yarn your tori as we dey do**
**based on our culture and tradition**

#### nah @oliverwilliams bring this Tori come our demot.

#### make we no forget to the support us with unah upvote, comment and resteem.

#### remember to follow @naijapidgin and you also fit join our WhatsApp where the plenty gist they happen [here](https://chat.whatsapp.com/C0Tbv4dXGxI7H4qwMl10Qs)

#### nah @mittymartz give us this fine avarta
![IMG_20180215_155325_695.jpg](https://steemitimages.com/DQmQkNYBpYh7mPEJV6KFqxCfneCsy8kYxgzH7Lg91z6zf7o/IMG_20180215_155325_695.jpg)
👍 , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , ,