Slave Encampment
naijapidgin·@naijapidgin·
0.000 HBDSlave Encampment
*Ma pipu my pipu how una dey, I trowey salute give una oooooooo. Make una all welcome to our ogbonge naijapidgin blog..* *Fellow steemians, how hustle? We thank God say market don dey green small small, it go beta very soon. @naijapidgin dey wish u a stressfree week ahead.* *As today go be, @naijapidgin don carry one arising mata come ur domot. Make we yarn how slave trade don hit we countri. Hw slavery don sell away wetin God give us*.  #### Wetin we mean by SLAVERY? *Slavery be one kind act wey be say individual go get freedom to buy, sell nd own oda individual as mean of property, dis one strong ooo. How person go own individual like him, wey be say na d same blood and bone.* *It don show for history say our fore-father don suffer for dis slavery of a thing, been sold from camp to camp wey be say d work dem dey no easy. Some implications dey for dis act wey don happen centuries ago Wey include; loss of some culture and acts.* *Make i leave dis mata, bcos say history don waka. Make we talk about d recent one wey dey hot for ground.* *Wetin we observe for d mata wey concern our country pipu wey libya hold as refugees, i believe say dis one na advance slavery, keeping pipu for camp in dis civilized world. I no blame dem sha, because say as i dey see am, na greener pasture dem dey find.* *Wetin we wan chuk mouth for today be; How we fit stop dis slave trade of a thing?* *make we no forget to the support our own naijapidgin so the we go fit the grow. make we no forget to the support @naijapidgin with our upvote, comment and resteem. nah @horlaide bring this one for us. you fit join our WhatsApp group where e dey happen here nah @martymitz give us the fine avarta* 