WETIN SARS DEY DO FOR NAIJA

View this thread on: d.buzz | hive.blog | peakd.com | ecency.com
·@naijapidgin·
0.000 HBD
WETIN SARS DEY DO FOR NAIJA
![](https://cdn.steemitimages.com/DQmVzisisYP22hS1oien1fwarFoRtTXDrYkGC3dg6TvHzXa/image.png)
[Source](http://citymirrornews.com/wp-content/uploads/2017/11/vllkyt257edp6mhtig.aa66b818.jpg)
*My people my people!!
How una dey this Friday morning...*

Omo una dey feel this cold so? My leg dey shake as i dey yarn dis yarn,, Unto the matter wey dey ground!

Dem talk say police na your friend, but naija pipo no say na lie because the police wey we get for naija dey harass person wella. But now we don even get one wey worse pass police, dem dey call dem *SPECIAL ANTI ROBBERY SQUAD* aka SARS, e too much for their body. Everyday na so so bad bad news we dey hear, the way Sars people dey arrest pipo wey no do anything, e too much. Any guy wey dey see for road be yahoo boy, if dey see young guy wey get car, de go stop am start to harass am, if e talk too much, dem go begin beat am blue black..

The one wey pain me be say, e get one girl wey dem dey call Julia Imaga, wey Sars pipo kill. The girl just write Waec finish last year, she and e bobo wey dem dey call *oh dollar*, wey be OOU student come dey waka, Sars come kill dem 2 because say dey suspect say the boy na yahoo boy.. My pipo, dey just suspect am o, dem no arrest am, dey just kill the boy, kill the small girl join.. The girl papa don cry tire. dem don kill plenty people wey dey innocent..

Our government dey pay people to kills us, naija people don protest tire, e be like say d protest dey make dem worse.. Bad people don dey use SARS commit crime.. Kidnappers don dey carry Sars pose to kidnap person. E get one boy wey dey waka for lagos, kidnapper come pose like Sars, as e wan carry the boy, people rush am come dey ask am for ID card, e no get, dem beat craze commot for e body dat day.. My own be say, If Sars no dey behave like dat, people no go dey carry their name commit crime.

Abeg naija pipo, make we dey careful oo.. Una know say people no too sabi cryptocurrency for our countri, make we just jejely dey do wetin we dey do, make dey no come think say we be yahoo pipo. Make we no follow anybody wey no get ID waka o.. Make we stand for our right anytime o..

*Wetin una think for this Sars matter?
Una don get any experience with Sars? Abeg talk am for comment make we learn.*

# Na @nmalove carry this matter come

*
### Footnote

**If you would like to support us, 
Please follow our [curation trail](https://steemauto.com/dash.php?i=15&id=1&user=naijapidgin) Or delegate SP to @naijapidgin account.

`We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows`

*
Join our discord severs for fun, interactions and voice shows [VIA](https://discord.gg/cDncwb)

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

> On discord we have the following shows and lectures:
* Real-Life Talk with @preciousimo 
[Tuesdays by 8pm]
* Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]
* Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]
* Steemit Diary + Amebo with @rebeccafl [Fridays by 8pm]
* Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

* Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it


> Naijapodgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde


![IMG_20180319_092844_398.jpg](https://cdn.steemitimages.com/DQmcu9FzGukGzVMZQhqhmw4NC5NxbetH6tzFSVBoGkNP1LL/IMG_20180319_092844_398.jpg)
Avatar designed by @mittymartz
👍 , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , , ,