WHICH WAY NIGERIA?
naijapidgin·@naijapidgin·
0.000 HBDWHICH WAY NIGERIA?
My country people, una good morning. Today na April 26th, 2018. No surprise say I dey tell una date o. I know say most of us no dey Sabi date again even some day forget the days of the week. Make I still remind una say today na Thursday. Small time we go enter weekend and the month go finish. Anyway make I no use too much talk start this morning. Today, the matter wey I go like make we discuss na the one wey concern is as Nigerians. During the week, e get two events we happen wey make me siddon come dey reason say, which way Nigeria?  The first one be say I dey inside bus dey go somewhere when I see one taxi knock on fine boy we stand for road dey on him own jeje. This boy land for ground come hit him head na so blood begin dey flow like water. You know wetin surprise me? People just gather am, some dey snap picture, some fold hand, some just dey shout and some dey cry while the poor boy dey for ground dey kpeme small small. My country people, no be dey suppose find motto rush am sharp sharp go hospital? Another one wey happen during the same week na where one policemen don go drink high finish na so kasala come burst between him and some guys wey Dem dey beer parlour together. Before person go say mama mia na so policeman cork gun burst one of the guy's Dem head. Youths Dem come because come gather this policeman come dey Lynch am. All these things come say make I ask una my country people, ##### 1. Why naija people dey find am hard to carry accident victim go hospital? ##### 2. Jungle justice, na the best way to handle mater? ##### E dey important make I hear wetin una get to yarn on top this Tori wey @zizymena carry come una domot. ***We still get WhatsApp group where every every dey happen. If you never join abeg click [here](https://chat.whatsapp.com/C0Tbv4dXGxI7H4qwMl10Qs)***  Na @mittymartz design this avatar for us.